Priesst Akonuche Remix Lyrics (feat. Victony & Shoday)

Ọmọ, both fear and faith dey ask you to believe in wetin you no dey see
Na you go choose

I go cut my coat oversize this year
I no waka reach here just to waka reach here
And if the tables no turn, me I go change chair
Wetin dem wan talk, I don’t care
God dey my side, I no fear

I go waka with akonuche
Pass Ebuka, I stubborn
Leave shame for back like bumbum
From Abuja to London
This year, dem go know say I don come

Say I come, I order bank oh
I give dem another swag oh
If Tinukẹ no holla back oh (Mtcheew)
No give am another chance oh (O dá naa)
Ah, thank God for the stamina
Ma waka-waka go zamina
No time to check calendar

Ohh, fast-fast, attack, attack oh
No do, no do gra-gra (Gra-gra)
This year, we go pack am (Pack am)
This year, we go stack am
Ṣe dem be no wan believe? ‘Lieve
But, we go reach there, we go map am (Map am)
I shine like a diamond oh
No be skincare, me no kasa (Me no kasa ohh)
Yeah-yeah

Go ask Ebuka, I stubborn
Leave shame for back like bumbum (Biggy bumbum)
From Abuja to London
This year, dem go know say I don come

Ko-ko ko
I’m knocking for blessings like ko-ko-ko
Money plenty for my ṣòkòtò
But I hustle pass aboki for Sokoto
Dem be no gree for me, mo ya ti were bọ
Can’t wait for blessings, I take it by force
Pay my money, ọga, mi ò rojọ
I cop the Rollie, aje, fuga kọ
Overtime big record, and I no go stop

Time wait for no f**king bagga, so
Brother, pick your ladder, dream so higher
Thou shall not chase no baka
‘Cause if you get the raba, dem go harder
So, I go cut my coat oversize this year
GLE, I go cop this year
Big mansion, I go cop this year
One big transaction go drop this year

Go ask Ebuka, I stubborn
Leave shame for back like bumbum
From Abuja to London
This year, dem go know say I don come

(Du-)